Pidgin English Nation
17 subscribers
78 photos
1 video
2 files
16 links
Pidgin English na our very own. This channel na for Africans and those wen love Pidgin English
Download Telegram
Amazing scholarship opportunity for people of between *18-34 years old* wen dey live or dey work for Lagos east. , if you apply , dem fit select you to join this life-changing program wen SAIL Empowerment Foundation dey organise

📚 *Details*:

- *Faculty dey Led by Co-Creation Hub (Cc-HUB)*
- *Format na Hybrid learning (1 day for-class per week + online sessions)*
- *Location na SAIL Innovation Lab, Ikorodu (visit sailab.ng for more information)*
- *Duration na 3 months*
- *Hands-On Experience: Work for real-life projects so dat you go become job-ready as a Digital Marketer.*

Last cohort get over *1,500 applications!* Only the best naim go get the scholarship, so take your time to answer all the questions carefully during the application process.

*Apply here*: 👉 https://bit.ly/SAIL_digitalM

No miss out on this incredible chance to secure your future!
This na for anybodi wen dey elderly and wen get elderly pipu around dem. Make una no miss this golden opportuniti o.

Date: December 28th, 2024
Time: 12:00 - 5:00pm
Location: Iganmode Grammar School, Oju-ore Ota, Ogun State.
My pipu how the celebrations? I don wear my Amebo hat 😀.

E get this YouTube channel wen dem dey call 'Never Married African ' dem don release this video. The title na ' Why Side-Chics dread the Christmas and New year holidays. Revelation from a former Side-Chic '

If you dey interested Google 'Never Married African YouTube channel ' to watch the video

Wahala dey o.
Vacancy dey for video editor

Type of work (remote global)

Skills

🔷Video editing and post production

🔷Make you know how to use Cllickup and the ones wen resemble am

🔷Make you get 2-3 years relevant experience

How you go apply

Step one : record one short video of yourself talk why you be the best person for the job

Step two : share links to work wen you don do before

Step three: send your resume and the money wen you go like dem to pay you to wit the step one and two requirements to hires.trends@gmail.com
Top 5 skills when everybodi suppose get for 2025



Ibeg no carry last o. If you no get these skills when I wan list👇 then 2025 na the best time to acquire dem.


🎯The first skill na loyalty. Na one of the hottest wen you fit get .No sector wen employers no dey use torchlight dey search for am. If you dey do wetin go fall your oga hand ibeg stop .If you be the kain person when only your mata dey dey important for your eye, no matter wetin you achieve (if you like climb Kilimanjaro) your mind go remain for potto potto.


🎯Hard work na skill number two. Forget those yarnings when dem go say you nid to work smart and not to work hard. Na lie. The truth be say you no fit work smart if you neva begin to work hard . You must understand system reach ground before you go fit become master for inside

🎯The third skill na focus. This one hard eh because so many mata go dey ground especially when you get assignment to do. Na dat time e go be like say something wen better pass don land. No fall mugu. The ability to bone naim go make you persin when solid like Zuma rock.

🎯Fourth skill na goodwill. Bad belle no be am o. No let body dey pepper you. The more you wish others well eh, the more your mind go sweet like Mr Biggs meatpie and when your mind sweet your brain go sharp. Beta ideas go dey flow left, right and centre.

🎯The last ogbonge skill na wetin oyibo dey call contentment . Dat skill eh go make you oga of your emotions. E go make you no dey borrow money before month end😉. You go fit pass Iya Basirat sweet stew. Fit bone that asoebi wen dem bring come your office . You no go dey pursue dat ting when dey reign today and begin dey chase another one tomorrow like pikin wen dey run after blow blow for party.

With these five skills your life go everly make sense not just for 2025 but for many more years to come.
Three things singles can learn from Trump https://youtu.be/xS7wUZCvsXU
If life give you pepper, ibeg make pepper soup 🍲. No let anything hold you back for this new month o. Na who win gold naim dem dey remember
I know you are already packing your bags to Japa😀

Nothing I go talk go make sense but before you book that Uber Ride to the airport , sha know what you will encounter when you reach there.

The mata don tie plenty wrapper😀

https://youtu.be/X-ib3mhGtU0?si=6ZpeY1ToXNyBXSrE
This na second half of the year. Congratulations to all of us. We still get time to make something meaningful out of this year.

Ibeg no give up. No say e don too late.

You still get time .
This life na jeje.

Nobody go fit drink your water .

No be who first graduate dey get the best job
Children dey very precious. All of us get duty to support them
This na December felicitations from my friends from Lyngual Labs
Hey Fam!! 🥳

*TOMORROW!* 🚀 go set.

Lagosians where una dey ?

CC hub dey do their *GAMES NIGHT*

Free food, free drinks

E never too late to register.

Na free to attend but you need to register.

[https://luma.com/8xzdpxsm]
Enjoy o. All work and no chop make jack a mumu boy 😁
Happy workers day o . And word of advice o 😂